Thursday, September 19, 2024

Di Pawa of Alliance and the Pain of Betrayal: Look BB Naija

Must Read

Big Brother Naija! If you never hear of Big Brother Naija, e be like say you dey under rock since. Na for that house wey drama dey, gbas gbos no dey finish, and alliances dey strong like super glue. But na the same house betrayal dey nack pipu like trailer. Mek we waka enter the matter wey dem dey call “di Pawa of Alliance” and the “Pain of Betrayal” for Big Brother Naija house. So, siddon gidigba and enjoy dis ride.

Alliance: When Two Good  Heads Better Pass One

For Big Brother Naija house, alliance na big strategy. E dey like when man dey for market, and him need people to help am price market. For this house, if you no get alliance, your own fit dey for back of the queue. Alliance na when two or more housemates gree to join hands form one kind friendship or team. Dem dey use this alliance take plan how dem go fit stay for house till dem reach final. Na alliance dey make dem see the real gbas gbos.

Na so we dey see housemates like Pere and Saga, Tobi and Miracle, White Money and Queen, Hermes, Bella, and Sheggz dey join hands. Dem dey make moves like Okocha, calculate like Einstein, and dem dey strategize like military generals. If you no get alliance for house, na to dey wait for eviction every Sunday remain for you. But if you get correct alliance, you go dey waka like King for house.

Betrayal: When Knife Enter Back

As alliance dey sweet for Big Brother Naija house, na so betrayal dey bitter pass raw bitter leaf. Betrayal na when your pesin, like your main gee, decide to carry you do ‘ojoro.’ E dey happen when one person for alliance begin to see say e better make e play solo or join another team. E go just switch side like chameleon, come dey plan how e go take use your own strategy against you. Na that time you go hear things like, “I thought you were my friend,” or “How could you do this to me?”

Who go forget the betrayal wey Pere show Saga that year? Dem two be like rice and stew, always together, but when e reach time to save himself, Pere take Saga play like football wey dem dey pass from one leg to another. And remember Mercy and Ike? Dem two love dey sweet like honey, but when e reach that time, Mercy no even think twice, she carry Ike name put for nomination. People for street begin shout, “Ah, Mercy! Ike, your guy?”

This kin betrayal dey pain well well because e dey come from person wey you trust, wey you don open body put hope say na him and you go dey till final. But last last, Big Brother house na game, and everybody dey fight for themselves.

The Amebo Cona: Alliance Wey Turned To Betrayal 

E get one time for ‘Pepper Dem’ season wey Mercy and Ike dey reign like King and Queen. Mercy come see say e dey better for her make she focus on her game, she kukuma nominate Ike for possible eviction. Ike look Mercy eye, Mercy sef look Ike eye, but Mercy eye talk say, “Na game o, make we no dey emotional.”

Another gbas gbos na that of Laycon and Erica. Laycon and Erica be like bestie dat year, dem dey close like bread and butter. But as Erica begin dey follow Kiddwaya, she come dey suspect Laycon say him no wan make she and Kiddwaya dey together. That na how their alliance scatter, and fight begin happen left, right, and center, yam pepper enter pipu eyes. Na Laycon later win the show, but that betrayal pain well well.

Make we face am, for Big Brother Naija house, if you no get alliance, you dey on your own. But if your alliance dey strong, e fit carry you enter final. Na the reason why people like White Money and Pere wey bin form alliances last long for the house. Even as dem dey chop Sunday rice, dem dey reason how dem go use alliance take reach final.

But make you remember, say even as alliance fit dey strong, betrayal fit happen anytime. If you trust person too much, e fit use you shine. Big Brother Naija house no be place wey you fit dey carry everybody for mind. E good make you dey smart like 2+2.

Trust But Verify O

Wetin we fit learn from all these gbas gbos and gbas for Big Brother Naija house? E clear say na to trust but verify. No put your life for person hand otherwise you go chop hot breakfast, because for this life, everybody dey hustle for themselves. Alliance na good thing, but make you get Plan B. If betrayal happen, no go cry for corner forever. Remember say for dis life opportunity go everly dey com, carry yourself up, and move on.

Sometimes, na the person wey you trust go use you do scapegoat. But if you dey smart, you go sabi when to shift go another side. No put your eggs for one basket, because if the basket fall, na all your eggs go scatter.

This our life be like Big Brother Naija, e no be ordinary show; na game of mind and strategy. Na who sabi play game well go last. Alliance dey important, but make you no put your full mind for anybody hand. Betrayal fit happen anytime, but if you sabi yourself, you go dey alright. Abi no be so?

- Advertisement -spot_img

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

- Advertisement -spot_img
Latest News

Abuja’s Nightlife: Karaoke Bars and Arabian Teas

Nigeria's capital city, Abuja, has a vibrant nightlife scene that beckons residents and visitors alike with a unique blend...

DO YO WANT THE WORLD TO SEE YOUR BRAND & BUSINESS?

- Advertisement -spot_img

More Articles Like This

- Advertisement -spot_img